Please permit my Pidgin English
because that is the only way I can fully express my Lagos experience.
E don tey wey I don dey hear say the land of Lagos nah the place wey you fit hustle yah way to the top. And I don dey find way to come Lagos since. To cut the tori short, after four years wey I don sidon for house (Edo state), I come get job for the almighty Lagos. The joy wey full my belle no be small tin o. Nah I begin promise everybody for my house say I go dey send moni from my salari (salari wey e be say I no get idia how much).
Photo crdt: Alistair Englebert Preston.
Mmm, my people, I enter Lagos for
Night. Nah my friend come pick me for park with keke, so we just dey gist till
we reach her house. I no even open eye see wahala wey dey road. De next day she
come show me how I go take enter bus reach were I dey go, nah I carry my two
legs begin the journey. As I trek come out reach main road I confuse, different
horn nah I dey hear, so-teyyyy bike horn sound like trela and trela sound dey
shake grand. To cross road nah elele but thank God I reach weer I dey go.
Wen I reach der, nah tori, tori wowo,
no bi wetin I fine go nah I see. Nah GNLD product dem say make I kon sell.
Shooo, I weak for de mata, abi nah mi no read wetin dem right well for dia on
line. Nah I kukuma kulee as I don waka kon Lagos, where I dey go again. De thin
wey scata my head be say dem kon do us training, kon select de pipu wey dey
want, dem no kon join me. See mi ooo, nah so my gbege for Lagos start.
Today go make am three years wey I
enter lagos and still my life neva change. I don fuel difrent hustle for dis
lagos. I sell bedsheet, makeup, food, Ankara material etc nah I chook bodi to
dey clean pipu house for weekend, still no show. As I dey so I don tire. I no
go lie I no hapi, wetin kon difrent inside mi and person wey no go school.
Dis Lagos nah suffa full am. My malee don tell me make I kon back but shame no
let me and I still wan give Lagos one last chance to do me well. if not I go
noh say Lagos no be for evribori, e dey pick people wey go make am, why odas,
nah yonda capet e dey wipe der dream.
My people. nah onli me waka kom o!.
628 days ago
Welcome to Lagos
5